Naija Fm102.7 na the original Naija radio station, with correct collabo of talk and music.
The talk talk part, include local and topical news, where we go use give our listeners space to take talk their minds for topical matters wey dey affect dem everyday.
The music, no be from only well known local musicians dem, but we also dey support our upcoming brothers and sisters wey need avenue for their new music.
We dey play all new and old music from our local Nigerian scene, plus our popular African songs.
The programme is aired during the Workchop show with Lady J.
Time: 2pm-2:30pm everyday.


